EGO!
Ego,
Na becos of you I go school
Make I for learn
Make I know things
Make I take get work
So that my life go better
Ego,
Na because of you I go market
I come build house
I come buy motor
I come chop well
You sweet no be small
Ego,
Na because of you I dey popular
My friends dem borku
My enemies yanfuyanfu
My elders sef respect me
Babes no dey finish
Ego,
Na you bring my palaver
No sleep again
No rest of mind
No where to hi de
E don get as e be
Ego,
Na many names you get
Oyibo call it money
Hausa call him kudi
Yoruba call her owo
As I see am so poverty no be curse.
By Chovwe Ogbe for http://nollywoodgists.com
Latest News
- Actress, Rita Akoji Speaks On Being Single
- Sarah Martins Reveals Her Admiration For Men Who G
- Daniel Regha Drops Review Of Newly Released Afrobe
- Veteran Actor, Kanayo O. Kanayo Gives Take On Issu
- Ladipoe Breaks Silence On Wizkid's Shade At His La
- Fireboy Refutes Claims Of Competition Between Him
- Apostle Femi Lazarus Sparks Outrage Online Over Cl
- Simi Opens Up On Reason For Lack Of Cordial Relati
- “I Made More Money Than My Teacher In A Day” – Seu
- Singer, Davido Hints At Quitting Music After His N