EGO!
Ego,
Na becos of you I go school
Make I for learn
Make I know things
Make I take get work
So that my life go better
Ego,
Na because of you I go market
I come build house
I come buy motor
I come chop well
You sweet no be small
Ego,
Na because of you I dey popular
My friends dem borku
My enemies yanfuyanfu
My elders sef respect me
Babes no dey finish
Ego,
Na you bring my palaver
No sleep again
No rest of mind
No where to hi de
E don get as e be
Ego,
Na many names you get
Oyibo call it money
Hausa call him kudi
Yoruba call her owo
As I see am so poverty no be curse.
By Chovwe Ogbe for http://nollywoodgists.com
Latest News
- Singer, Davido Discloses Favourite Artistes In Ter
- “Marry Yourselves" —- Uche Ogbodo Advises Nollywoo
- Zubby Michael Finally Breaks Silence, Mourns Late
- Israel. DMW Disagrees With Doctor’s Claim
- Davido Reveals Afrofusion As His Genre Of Music
- D’banj Tries To Make Peace With Ex Business Partne
- “He Was The First Artiste That Showed Me Help When
- “The Way My Parents Were Portrayed Wasn't The Best
- Davido Gives Brutal Reply To Producer's Allegation
- Nollywood Industry Mourns Death Of Veteran Actor,